You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria kidnap: Police don rescue Americans, Canadians for Kaduna
Police say dem don rescue di four Americans and Canadians wey dem bin kidnap on Tuesday for Kaduna, Northern Nigeria .
Na di State Commissioner of Police, Mr Agoyle Abeh, talk dis one give tori people.
Im say na police find di foreigners and dem don arrest one suspect on top di kidnap matter.
Mr Abeh talk say dem dump di Americans and Canadians for bush by 6 am on Saturday.
Dis na after heavy searching wey di police bin do.
E talk say dem also dey try to catch all di people wey dey involved make dem face justice.