Nigeria: INEC don make chance for people to still get PVC

Read am in 1 mins

Di Independent National Electoral Commission (INEC) for Nigeria don talk say person fit get dia Permanent Voters Card (PVC) if e don lost, or dem never collect am.

Na for dia Twitter handle dem use talk di tori, as di commission don release date for timetable for general elections wey go happen for 2019.

As e be so, even if you don loss your card or you move go new place, dat one no go stop make person no get chance to vote.

Di commission dey try all dem fit do, make nobodi complain say dem no get chance to vote wen elections go start next year for di country.