You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
'Fire and Fury: Inside the Trump White House' go get film
Read am in 1 mins
64-year-old Michael Wolff wey write 'Fire and Fury: Inside the Trump White House' say im wan do film from di book.
Di book reveal all di things wey don happen inside White House within di first year of Trump as president.
Before di book come out for early January, people don already dey long queue dey wait for dem to start to dey sell dis book.
Na Wolff go be di director for di film wey fit be TV series or Movie.
But US President Donald Trump say di book lie.