You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Harry Uzoka death: Police charge two over murder of popular model
Police charge two models George Koh, 24 den Jonathan Okigbo, 23 for di murder of British-Nigerian model Harry Uzoka.
Na for statement na im di London Metropolitan Police say di two men, appear for court on Tuesday, where dem confirm demma names, date of birth den addresses.
Uzoka who dey on di books of Premier Model Management, die from single stab wound.
Di two men go appear again for court on Thursday, 18 January.
Di allegation be say dem attack Uzoka, 25, outside some flats inside Shepherd's Bush for London.
Dem charge Koh with "possession of offensive weapon."
Di police say two more people dey under investigation, 27-year-old den another 28-years old guy but dem release dem while investigations dey happen.
Uzoka be di fourth person wey dem stab to death for London dis year. News of in death shock chaw menerz sake of dem hail am as icon give black boys for UK.
End of Di one wey oda users dey read well well