You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria na di second worst country for electricity
Read am in 1 mins
Dem don rank Nigeria as di second worst country wey dey produce electricity for di world.
Spectator Index, wey dey chook eye for how things dey be for countries dem, nack dis tori put for Twitter.
Dem open di account for 2013 and e no dey clear who get am or dey manage am.
Spectator Index say na 137 countries dey inside di list and na Yemen worse pass.
Di countries wey dey follow Nigeria na Haiti, Lebanon and Malawi.
Ethiopia dey number 37, South Africa carry 41 and another African country, Algeria na 45 dem dey.