You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Cameroon secessionist leader dem deh Abuja
Chris Anu, Southern Cameroon Communication Secretary, tell BBC Pidgin say dem leaders wey some gun men arrest for Abuja over one week ago, go meet and tok with dei lawyer dem for Monday or Tuesday this week.
"We don locate our president and odas for Abuja, Nigeria capital city.
"Nigerian Foreign Ministry and Police Inspector don confirm'am. Dem promise say deh no go send our leaders dem back for Cameroon," Anu tell BBC Pidgin.
Julius Sisiku Ayuk Tabe, secessionist leader with 11 odas bindi hold meeting for Nera Hotel for Abuja when some gun men abduct dem.
Na Nigerian authorities arrest Southern Cameroon leaders and dem dey for Abuja, de Anglophone Cameroon secessionist group don confirm.
African Bar Association, (lawyers group) and Femi Falana Southern Cameroon leaders dei lawyers di condemn de abduction, say deh go take legal action.
End of Di one wey oda users dey read well well
Even Amnesty International, Human Rights body chuk mop for de mata say, "if de Anglophone leader dem go back for Cameroon e go hard for dem for get fair trial and torture go fit be dei portion."
Southern Cameroon don put condition say; if refugee dem no return for kontri, government komot all military from Anglophone region dem, deh release teachers, students and odas wey dey for ngata (prison) for seka Anglophone crisis, school no go resume.