Funke Akindele Avengers film aproko: Why Nigerians dey jolli

Wia dis foto come from, Instagram/funkejenifaakindele
Wen di latest Avengers film by Marvel enter cinema, e be like say Nigerian fans go get extra swag go watch am.
Na because e be like say Nollywood movie superstar, Funke Akindele go show inside di film. And Twitter don catch fire.
Her name show for IMDb, one website wey dey carry film information, say she go be Dora Milaje member - dem bi woman soldier dem wey dey do bodyguard for Wakanda king T'Challa, a.k.a. Black Panther.
Avengers: Infinity War suppose show for cinema for May 2018 and dem go do another one May 2019.
Marvel never open mouth on top all di people wey go show for di film, but tori be say e fit reach like 67 different actors dem, so fans no fit control dia jolli.
BBC Pidgin don try reach Funke Akindele make she talk her own inside di matter.

Wia dis foto come from, IMDB
But e no stop Nigerians to talk dia own.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Some dey happy say Nigerians dey carry dia talent go international.
End of Di one wey oda users dey read well well
Even as e dey sweet people, some of di comments sha just dey make person laugh.
Like one person wey talk say whether na 'Jenifa' abi Funke hersef go show for di film.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2

End of X post, 3
Funke Akindele dey very popular as she get her own film company wey dey run things.
And her show 'Jenifa' dey make people laugh well-well.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Some other people feel say cinema go full wit plenty people wey just one see di actress for di film.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 4
If she show, e go be major crossover of Nollywood into one of Hollywood biggest film wey dey make plenty money.
Plus e fit open ground for other collabo for di two industries.