You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria: 36 prisoners don escape prison for Akwa-Ibom State
Na like four prisoners don die and many don escape for one jailbreak wey happen for Akwa Ibom State, south-south of Nigeria.
Dis one happen for Ikot Ekpene.
Government talk say e happen as some prisoners attack kitchen workers for di prison. Na di axe wey dem carry from di kitchen dem use take break di door so dem go fit escape.
BBC Ishaq Khalid report say na when dem dey fight di prison workers na im dem shoot four inside dem. Although dem catch some of dem, na 36 escape.
Government say dem dey find dem.
Di prisoners also injure dia fellow prisoners for head during di attack with di axe wey dem collect from from one of dem wey dey work for inside di prison kitchen.
Nobody know wetin cause di jailbreak but no be today jailbreaks don dey happen for Nigeria.
According to tori, between 2009-2014 na like 2000 prisoners escape prison dem for Nigeria and dem no catch many of dem back.
End of Di one wey oda users dey read well well
Authorities say dem dey investigate dis latest incident.