Di Falz Experience: Wetin pickin find go dia?

Falz

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Falz don na big star wey dey use im music talk about many things wey dey happen for society
Read am in 2 mins

Nigerian rapper, actor and comedian, Falz di Bahd Guy don shake di city of Lagos with im first show for Eko Hotel.

Di show wey suppose start by 8pm start one hour later on sake of say di audience bin never too show by dat time.

Di event combine all di things wey people know Falz for, including im comedy and im acting.

But one interesting thing happen for di event. Mr Joseph Oru tell BBC News Pidgin say im see small pickin for di event.

"I bin see pickin dem for di event as people bin carry dia family enter di event."

"Di thing wey enter my mind as I see di pickin dem na say maybe na di sponsor plan to promote family for di event. But I no think na good idea as di kain things wey dis pickin go take dem eye see for dis kain show e no dey proper," na wetin im talk.

BBC News Pidgin also talk to one parent Rose Warren to know wetin she feel on top di whether pickin suppose see road enter those kain shows.

"I no think say pickin suppose go dis kain events because children dey chook eye put everything well-well and dey copy wetin dem see, if you want make your pickin grow well, you no go do dat kain thing."

All di artiste wey follow Falz perform na people wey don already sing for im song before, like Simi, Yemi Alade, Reminisce, Phyno, Reekado Banks, Ladipoe, Chyn, Wande Coal, Ycee, and Davido.

Many people wey go di show talk say na di best for 2017.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

One person talk say no other show fit better pass di Falz Experience again.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Dis person dey bow for as Falz open im show; e bin climb down from rope like James Bond, sotay crowd bin dey shout.

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 3

Banky W wey also be Nigerian artiste carry dey praise di work wey Falz do for im concert; say na one if di best production wey im don see for im life.

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post

Dis person say di show na di best and thank give all di people wey perform.