You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
DR Congo: Life sentence for rapists dey sweet UN belle
United Nations don hail how court for Democratic Republic of Congo don jail one lawmaker and ten militiamen dem accuse say dem rape young girls.
Tori be say di men belong to one group wey dem call "Dieshi ya Yesu" - wey mean "Army of Jesus" for Swahili. Dem don sentence dem to live di rest of dia life for prison.
Dem say dem rape 46 children, including one baby join sef.
Na Frederic Batumike, wey be lawmaker for South Kivu province be di leader of di group and im join di people wey dem give life sentence.
Maman Sidikou, wey be head of MONUSCO, wey be peacekeeping force for di country, say dis kain judgement never happen before and na correct thing as dem dey try make sure say dem punish anybody wey do sexual violence against another person.
Im also talk say di judgement mean say nobody big pass di law.
Na kidnap dem kidnap dis children wey dem rape between 2013 and 2016.