Nigeria: Army go chook eye for cadet wey dey give dia uniform to Fulani herdsmen

Nigeria army recruit dey train

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI/AFP/Getty

Wetin we call dis foto, Nigeria Army say dem dey train dia cadet for strict and discipline environment.
Read am in 1 mins

E don tey we people dey wonder, where Fulani herdsmen dey take get military uniform wey dem dey use attack people sometimes.

Di fear be say e fit be from some cadet wey dey for Nigeria Defence Academy. Dat na why di Academy say dem dey chook eye for di mata.

Recently some Nigerian people complain on top twitter say dem don see some cadet dodge enter town for Kaduna, North West Nigeria.

Dem notice say di cadets dey leave dia uniform and other property for di hand of Fulani herdsmen for many-many days.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Academy PRO Major Musa Yahaya, tell BBC Pidgin say, di tori dey "dey strange to di academy." He say dat na why dem wan chook eye inside mata.

Dia worry be say, di Fulani people fit use di uniform go do wetin dem no suppose do.

Military training for cadet na serious business and di training suppose dey strict.