Ghana: Wetin people dey talk on top homosexual matter?

Ghana President
Read am in 2 mins

E be like some people for Ghana dey vex on top something wey dia president, Nana Akufo-Addo bin talk when e dey do interview with Aljazeera.

For di interview, im talk say di talk-talk on top di matter of homosexuality never reach di level way dem go talk whether dem wan change di law for Ghana.

Ghana no get exact law wey ban homosexuality but for section 104(2) for di Ghanaian Criminal Code, e talk say: "Unnatural carnal knowledge is sexual intercourse with a person in an unnatural manner or with an animal".

Dis one make people begin talk, some say di president dey against di culture and religions for di country, while others think say wetin di president talk for di matter good for where im bin dey as e dey do interview. Dem call am say e dey "intelligent" as e talk like that.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

One of di groups wey no really feel wetin im talk for di interview na di Christian Council for Ghana.

Di General Secretary for di Council, Kwabena Opuni Frimpong talk say make di president come clear wetin im talk on top say e dey against dia culture and religion.

E talk say make di president take example from wetin late president John Evans Attah Mills bin talk say dem no go allow same sex marriage for law for di country.

One lawyer for Ghana wey dem dey call Ace Anan Ankomah try to explain wetin di law dey talk for di matter on top Facebook.

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post