Nigeria: Governors go get remaining Paris Club Refund

Wia dis foto come from, Nigerian Government
Governors for Nigerian go dey smile anywhere dey hear di tori say President Muhamadu Buhari don approve payment of di remaining balance of money from Paris Club Refund to dem.
President Buhari give di order on Monday 27 November, after im sidon do meeting with di governors dem.
Tori be say di money na to help governors pay workers salary wey dem owe before Christmas. For some Nigerian states, workers never see salary for more than 6 months.
Before now, plenty governors no use di first Paris Club Refund money di president bin give dem to take clear workers salary wey dem bin dey owe.
According to di Nigeria government twitter account, di President order say make di minister wey dey in charge of Finance, Budgets and National Planning and di Central Bank Governor begin process di payment.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di meeting wey di president hold with di governor dem discuss matter wey concern Nigeria economy, workers salary, relationship between di state and federal government and some oda tins.
Paris Club Refund na money wey group of rich countries dey give other countries wey bin dey experience hardship.
Paris Club dey provide money to country dem wey dey owe debt but no fit pay again.
End of Di one wey oda users dey read well well










