Uhuru Kenyatta promise to unite Kenya for inauguration

Uhuru Kenyatta in the Nairobi stadium, 28 November

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Mr Kenyatta go begin serve im second term as president

Uhuru Kenyatta put hand for chest, say im go 'join' Kenya together as dem swear am in for second term as president.

Im talk for di inauguration for di capital Nairobi, where im say im go try to chook some of di opposition idea dem "in di spirit of inclusivity".

Opposition no show face for di ceremony.

Two people bin die when police clash with opposition supporters for di city.

Opposition leader Raila Odinga announce say im go swear imself in as president next month.

Earlier today, Kenyan police dey fire tear gas to control crowd of thousands of people wey dey try force dia way enter Kasarani stadium for Nairobi, to attend di swearing-in ceremony.

A man waits ahead of the inauguration ceremony for Uhuru Kenyatta at Kasarani Stadium in Nairobi, Kenya, 28 November

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Some of Kenyatta supporters dey lucky pass, as dem see seat inside di stadium
People fall as police fire tear gas to try control a crowd trying to force their way into a stadium to attend the inauguration of President Uhuru Kenyatta in Nairobi, Kenya, 28 November

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, People bin fall down as police fire tear gas outside di stadium

Di Supreme Court bin cancel di presidential election wey dem do for August because of wetin dem call "irregularities."

Mr Kenyatta win di re-run, wey happen on 26 October, by 98% of di vote, on top say na only 39% voters come out.

Dem also swear-in President Kenyatta deputy wey be William Ruto.

Performers from Maasai tribe

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Performers from Maasai tribe dey among those wey entertain for di ceremony