Pistorius prison punishment don double on top girlfriend im kill

Oscar Pistorius

Wia dis foto come from, MUJAHID SAFODIEN/AFP

Wetin we call dis foto, Oscar Pistorius say im bin think say na thief wey enter house when im shoot toilet door four times, come kill im girlfriend Reeva Steenkamp

One high court for South Africa don increase Olympic athlete Oscar Pistorius prison punishment to 13 years and five months unto say im kill im girlfriend.

Government lawyers talk say di original six years dem nack Pistorius wey kill Reeva Steenkamp too short.

Di Supreme Court of Appeal come increase di time im go do inside prison to 15 years, minus di time Pistorius don already spend for prison.

Pistorius claim say na mistake im take shoot Ms Steenkamp for Valentine's Day for 2013 because im bin think say she be thief wey enter im house.

Oscar Pistorius

Wia dis foto come from, Charlie Shoemaker/AFP

Wetin we call dis foto, Di Oscar Pistorius case na one of di most popular court mata for South Africa

For di original case, di lower court no wan nack Pistorius 15 years because dem agree say im regret di thing wey happen and dem believe im go change.

So na five years for manslaughter dem give am, wey mean say na mistake im take carry gun shoot Ms Steenkamp, im no get mind to kill am.

But wen government lawyers carry di case go court again for 2015, court say na murder, wey mean say, na with mind im plan to kill Ms Steenkamp.

Reeva Steenkamp

Wia dis foto come from, AFP/Getty Images

Wetin we call dis foto, Reeva Steenkamp be popular fashion model before she die for 2013

Na four times Pistorius shoot Ms Steenkamp through di toilet door for im house wey dey Pretoria.

Pistorius na popular disabled runner wey win six gold medals for paralympic.

Di South African runner make history wen im become di first disabled runner wey run for di 2012 London Olympic games with artificial leg.

Na for baby dem comot im leg from im knee reach down.

Oscar Pistorius

Wia dis foto come from, PETER PARKS/AFP

Wetin we call dis foto, Oscar Pistorius win six gold medals for paralympics
  • August 2012: Run for di London Olympics and Paralympics, wia im win gold medal
  • February 2013: Shoot im girlfriend Reeva Steenkamp
  • March 2014: Court case start
  • September 2014: Judge say Pistorius dey guilty for homicide
  • October 2014: Pistorius start five-year prison punishment
  • October 2015: Dem move am go house arrest
  • December 2015: Appeal court change di court judgment to murder