Meet Taekwando wonder woman

Wetin we call dis Video, Taekwando Wonderwoman

Thursdaline Peter na Nigeria youngest Taekwando referee wey dey win plenty award for Asia and Africa; she bin dey represent Nigeria well-well for competition all over di world.

But one thing wey di 30-year-old like pass Taekwando na to help women defend demself from man wey dey rape, or beat dem.