Nigeria: President Buhari don sack Babachir Lawal and Ayo Oke

Wia dis foto come from, Getty Images/Nigeria Government
Nigeria President Muhammadu Buhari don sack Secretary to di Government of di Federation, Mr Babachir David-wey bin dey on suspension and di Director General, National Intelligence Agency (NIA), Ambassador Ayo Oke.
Statement wey dem release from di president office say im take di decision after im chook eye well-well inside di report wey di panel wey Vice President, Prof Yemi Osinbajo, bin lead, to investigate as dem bin accuse Mr Babachir David Lawal, and Ambassador Ayo Oke of different cases of corruption.
Di President accept wetin di panel talk, to sack di two of dem from office.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post
President Buhari also say make dem set up one three-member panel wey go look how Nigeria Intelligence Agency take dey run things, and make recommendations.
Di president don appoint Mr Boss Mustapha as di new Secretary to di Government of di Federation.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
How di tori don waka
Na for April 2017 na im President Muhammadu Buhari first suspend Babachir Lawal, wey dat time be very powerful Secretary to Federal Government of Nigeria because of accuse wey dey on top im head say im no follow wetin di law talk to give contract for di Presidential Initiative on North East.
Dat same day di President suspend Ayodele Oke, di Director-General of National Intelligence Agency for Nigeria because of di plenty amount of foreign money wey di office wey dey fight corruption for di country; Economic and Financial Crimes Commission discover inside one person house for Ikoyi, Lagos.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dat time dia suspension shock people because when di matter of wuruwuru wey dey happen inside contract for North-East Nigeria start for January 2017, even di president office bin say Lawal hands dey clean, after di National Assembly bin accuse am say im dey do corruption.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
For di Director-General of National Intelligence Agency (NIA), im own be say na money wey reach $43m na im di office wey dey fight corruption see say dem hide inside person house for Ikoyi, Lagos but Oke come out talk say na im agency get di money.
Torch lighting wey EFCC do, show say di money ($43m) na balance wey remain from di total money, $183m wey di National Intelligence Agency bin collect to spend for di 2015 general elections.

Wia dis foto come from, AHMED OUOBA










