Monkeypox: Nigeria don confirm 6 new cases inside 4 states

Wia dis foto come from, Wikimedia
Nigeria Government don confirm six new monkeypox virus case for di country.
Monkeypox na sickness wey no get cure for now and na animals like squirrel, rat and monkey first carry di disease give human dem.
Minister of State for Health, Osagie Ehanire, on Friday 27 October, say di confirmed case dem dey for Abuja di country capital, Enugu for eastern Nigeria, Bayelsa and Akwa Ibom for di southern region.
Dis na 10 days after di Nigeria Centre for Disease Control confirm say na only three people na im get di monkeypox virus disease for Bayelsa State.
For dis new case dem, di Minister say Abuja and Enugu get one person each wey dem don confirm say get di sickness, while Bayelsa and Akwa-Ibom get two people each wey dem confirm say get di monkeypox virus.
Im say investigation dey go on to see whether any of di new cases get link with di Bayelsa area, where di sickness start.

Wia dis foto come from, flickr
Di government say make di public no panic, because dem dey work with all states where di disease affect to ensure say dem manage am well.
According to di tori wey Nigeria Centre for Disease Control give BBC News Pidgin, na 94 people dem dey suspect say fit get di Monkeypox virus for eleven state dem (wey be Akwa Ibom, Bayelsa, Cross River, Delta, Ekiti, Enugu, Imo, Lagos, Nasarawa, Niger, Rivers) and Abuja.
End of Di one wey oda users dey read well well
So far, di monkeypox never kill anybody since September when e start for Nigeria.










