Uganda and Somalia wan join hand to fight al-Shabab

Somali president Mohamed Farmaajo with army uniform

Wia dis foto come from, VILLA SOMALIA

Wetin we call dis foto, Somalia president say im dey ready im army to defeat al-Shabab
Read am in 1 mins

President Yoweri Museveni of Uganda and di Somali president Mohamed Mohamed‏, don do meeting on top terrorism matter wey dey affect dia two countries.

President Mohamed enter Uganda on October 22 for official visit after im accept di invitation wey president Museveni give am.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Di two leaders meet for State House, Nakasero to talk about how Uganda go fit support Somalia with military help for dia campaign against al-Shabab.

Dis meeting dey hold after di October 14 terror attack wey happen for Somali capital Mogadishu, wey kill 358 people; dozens of others still dey miss.

Uganda na one of di countries wey get troops for Somalia under di African Union Mission in Somalia (AMISOM), and as Museveni government dey prepare to fight di terrorist group comot from di country, Uganda say dem need leaders of di countries wey already get soldiers for Somalia, to increase number of soldiers wey fit join dem fight al-Shabab.

President Mohamed go also travel to Djibouti and Ethiopia to ask for military help from di leaders of dis countries dem.