You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria: Why dem call am Operation Python Dance II?
Operation Python Dance ll na di code name Nigeria Army don give di latest military operation for South-East Nigeria.
Nigeria military don talk say di Indigenous People of Biafra (IPOB) na terrorist group because dem dey do violence.
But why Operation Python Dance II? Python dey dance? E don dance before?
Why this kain code name?
Ok, Make we put am for reverse gear together and enter history small.
First of all, code name for military operations na something generals all over di world dey use when dem don ready to mobilise soldiers go battle.
Na for World War One di thing first start but na for World War Two e come popular well-well.
One of di reasons na because e go quick and easy for soldiers, media and ordinary civilians to remember and use.
End of Di one wey oda users dey read well well
Military code names suppose get these rules:
- Di name no suppose expose di work di operation wan do.
- Di name suppose sharp so people go remember am.
- Code names wey get Roman and Greek names good well-well.
Since Nigeria President, Muhammadu Buhari enter government for 2015, some of the code names di military don use for their operations be this:
1. Operation Iron Fence
This na di operation di military start for South-East to fight armed robbers, hooligans and kidnappers.
2. Crocodile Smile I
This na South-South operation wey military use for August 2015 to stop things like oil bunkering and Niger Delta militants.
3. Python Dance I
Python don dance before for South-East. That time, di operation na for Anambra state. Dem do am to fight robbery, kidnapping, cultism and di operation last for one month.
4. Operation Crackdown
This na North-East operation wey Nigeria Army use to clear Boko Haram fighters for Sambisa Forest.
5. Operation Tsare Teku
This Nigerian Navy operation happen for Niger-Delta region, South-South Nigeria to fight pirates wey be thief for sea.