You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria: Police don catch Ifeanyi Dike wey escape custody
Police for Nigeria don catch Ifeanyi Dike, wey been escape from police custody for August .
Di special anti-robbery squad catch am for Jos, Plateau State, north central Nigeria early morning on Friday.
On di 21st of August 2017, Ifeanyi Dike run commot from police hand for police station for Port Harcourt, south south Nigeria.
Police bin arrest am with body parts of one eight year old girl, wey dem say im kill for rituals.
Im escape dat time cause many reactions from Nigerians as police come under hammer say how dem take allow di suspect escape.
Dike na 200 level student of di University of Port Harcourt wey dem arrest as dem suspect say im also rape di girl before im kill am.
Rivers State Police talk say im bin dey go throway di body when dem catch am.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di papa of di girl wey join di search party to look for im pickin when she disappear talk say di suspect na im relation.