Boko Haram: Nigeria dey buy 12 war jets from US

Super Tucano A-29 plane

Wia dis foto come from, Ryan CallaghanReleased

Wetin we call dis foto, Nigeria go use di Super Tucano A-29 plane fight Boko Haram
Read am in 1 mins

United States Security headquarters, wey be Pentagon, don inform di US Congress say dem don conclude plans to sell 12 Super Tucano A-29 war planes to Nigeria.

Dem say di planes, plus other things wey go follow dem, go reach like $593 million.

Super Tucano A-29 plane

Wia dis foto come from, Dillian Bamman

Wetin we call dis foto, Di plane dey also help pilot to see enemy well, well for night

Nigeria wan buy di 12 Super Tucano A-29 planes and other weapons because dem want use am fight Boko Haram.

The Embraer EMB 314 Super Tucano, also named ALX or A-29, na one sharp attack war plane wey dem dey take monitor enemy and fit see enemy well, well for night.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Na former President Barack Obama government been plan to sell di plan dem to Nigeria but im government delay to sell dem after Nigeria military bin make mistake for one Air operation for January 2017.

Dat time, na like 90 people, especially women and children, na im Nigeria army take mistake kill when dia plane bomb one camp for North-East Nigeria, where thousands of people wey run from Boko Haram dey stay.