Cigar don wear new look for Senegal

Cigar packaging for Senegal don change. Now, wetin you go see on top cigar packet na photo of sick people to show wetin cigar smoking fit do.
Government don make am compulsory say make people wey dey sell cigar write tins like ''smoking dey cause slow and painful death'' or ''smoking dey lead to impotence'' join with photo of people wey dey suffer sickness.

Wia dis foto come from, Chris Hondros/ Getty Images
Why Senegal dey take the lead ?
Senegal health minister, Awa Marie Coll Seck, talk say government chook eye inside di matter and na wetin dem find na im make dem make dis law.
''20% of young boys wey still dey school dey smoke plus 10% of girls dey do am. We no want make im reach 50% or more dan sef, we wan make e stop.''
Smoking dey kill 6 million people every year, and na for South Africa and some parts of North Africa e bad pass. But experts talk say di wahala don dey spread go poor developing countries wey still dey grow.

Wia dis foto come from, Cameron Spencer/Getty Images
Africa market na good opportunity for tobacco industry because African countries no dey make strong laws to protect dia people like developed countries.
Younger Africans don dey smoke more too and dis na wetin make Senegal take action. Di anti-smoking law wey dem do for 2014 na one of di strongest for di world.
End of Di one wey oda users dey read well well
With dis law, you no go fit smoke for public place and you go enter yawa if dem catch you say you dey sell cigar to underage or for school area.

Wia dis foto come from, Cameron Spencer/Getty Images
Na about 1 billion people nai dey smoke tobacco around di world.
. 5.8 trillion cigarettes na di number wey people smoke for 2014 alone.
. E dey kill about 6 million people around di world every year.
. 4,000 na di number of chemicals wey dey inside tobacco, including carbon monoxide, arsenic, cyanide and benzene. 250 of dis chemicals dem dey harmful and 50 of dem dey cause cancer
.










