You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Champions League Quarter finals draw: Chelsea vs Real Madrid, Man City vs Bayern Munich, Victor Osimhen, Benzema, Fernandez and players to watch
Chelsea go face defending Champions Real Madrid for di Champions League quarter-finals.
Premier League champions Manchester City go play six-time winners Bayern Munich.
Inter Milan go jam Benfica and AC Milan go go up against fellow Italian team Napoli.
Di two leg quarter finals go hold on Tuesday and Wednesday 11-12 April with return games for 18-19 April.
Champions League Quarter Finals Draw
Real Madrid v Chelsea
Inter Milan v Benfica
Manchester City v Bayern Munich
AC Milan v Napoli
End of Di one wey oda users dey read well well
Possible Semi finals
𝐒𝐞𝐦𝐢-𝐟𝐢𝐧𝐚𝐥 𝐨𝐧𝐞:
AC Milan/Napoli vs Inter Milan/Benfica
𝐒𝐞𝐦𝐢-𝐟𝐢𝐧𝐚𝐥 𝐭𝐰𝐨:
Real Madrid/Chelsea vs Man City/Bayern Munich
Route to di Finals
Real Madrid/Chelsea/Man City/Bayern v AC Milan/Napoli/Inter/Benfica
When is Uefa Champions League Quater final
Unlike oda times wey dem dey cede teams for draws, dis time ceding of teams no go dey and teams from di same kontri fit play each oda.
Di quarter-final first legs go happun on Tuesday 11 and Wednesday 12 April, 2023 while di return legs dey fixed for 18 and 19 April, 2023.
Di semi-finals go be on 9 and 10 and 16 and17 May 2023. Di final go shele on Saturday, 10 June for di Ataturk Olympic Stadium, Istanbul, Turkey.
Road to di Quarter-Finals
Chelsea fight back from dia 1-0 loss for di first leg to beat Borussia Dortmund 2-1 on aggregate, but Tottenham wey Premier League fans hope bin dey on to also qualify lost 1-0 over two legs to AC Milan.
Manchester City play 1-1 dia first away leg for Germany against RB Leipzig, but dem sama di Spanish side 7-0 for di Etihad stadium to qualify.
Manchester City hit man Erling Haaland score five goals for di match on Tuesday.
Anoda top English team Liverpool lost 5-2 for dia home afta reigning European champions Real Madrid beat dem 1-0 for di second leg on Wednesday.
Europa League quarter finals draw
Immediately afta di Champions League draw, di Europa League quarter-finals, semi-finals and final draw go follow.
Di teams wey dey di draws na:
- Bayer Leverkusen (Germany)
- Feyenoord (Netherlands)
- Juventus (Italy)
- Manchester United (England)
- Roma (Italy)
- Sevilla (Spain)
- Sporting Lisbon (Portugal)
- Union Saint-Gilloise (Belgium)
Manchester United beat Real Betis 5-1 for dia last-16 tie while Premier League leaders Arsenal comot from di tournament on Thursday afta Sporting Lisbon knock dem out with penalty shootout wey end 5-3.
Dis na afta dem play 1-1 for regulation time.
Di Europa League quarter-finals go happun on 13 and 20 April for di two legs, while di semi-finals dey scheduled for 11 and 18 May, 2023.
Di final go take place on Wednesday, 31 May for di Puskas Arena for Budapest, Hungary.
Europa Conference League draw
Dem go also do di draws for di Europa Conference League Quarter-Finals and semi-finals.
Di teams wey dey di Europa Conference League na:
- Anderlecht (Belgium)
- AZ Alkmaar (Netherlands)
- Basel (Switzerland)
- Fiorentina (Italy)
- Gent (Belgium)
- Lech Poznan (Poland)
- Nice (France)
- West Ham (England)
Di last time West Ham win any European trophy na 1965. Dem qualify for di last eight of di Europa Conference League afta dem beat AEK Larnaca 6-0 on aggregate.
Di Europa Conference League quarter-finals go happun on 13 and 20 April, while di semi-finals go be on 11 and 18 May.
Dem fix di final on Wednesday, 7 June for di Eden Arena for Prague, Czech Republic.