You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Man City vs Man United highlight: Hat-trick for Erling Haaland and Foden for Manchester derby
- Author, Victor Ezeama
- Role, Broadcast Journalist
Di much anticipated Manchester derby between Manchester cuty and Manchester United end in a nine goal game wit City winning 6-3.
Dis na di first competitive Manchester derby wia dem go score plenty goals.
Anthony Martial score twice for di game and also im first league goal in over one year - dis na afta di Brazilian forward, Antony bin score as second half begin.
But e no dey enough to save dem from di six goals wey Manchester city take beat dem.
Erling Haaland and Phil Foden both score hat-trick each.
Dis na di first time two players dey score three each for Manchester City for di same Premier League match.
Haaland also break Michael Owen record as di fastest player to score three hat-tricks in a row.
Manchester United coach, Erik Ten Hag go face anoda test today as di dey meet Manchester city dis afternoon.
End of Di one wey oda users dey read well well
Pep Guardiola side dey look to close di gap on leaders Arsenal to one point again.
Dis na anoda derby game afta di north London derby on Saturday between Arsenal and Tottenham Hotspurs.
Second Half KICK OFF
FULL TIME: Man City 6-3 Man Utd
90 mins: GOAL! Man City 6-3 Man Utd
Anthony Martial score from di penalty kick.
89 mins: PENALTY for Man Utd
Man City 6-2 Man Utd
Joao Cancelo bring down Anthony Martial inside di box.
87 mins: Casemiro shot from outside go over di bar.
85 mins: GOAL! Man City 6-2 Man Utd
Anthony Martial score United second goal.
80 mins: Joao Cancelo step over di ball and sell Bruno Fernandes wey chop yellow card.
78 mins: Thanks to dat hat-trick from Phil Foden.
Dis na di first time two players dey score three each for Manchester City for di same Premier League match.
72 mins: GOAL! Man City 6-1 Man Utd
Phil Foden don im own hat-trick too! Jack Grealish slip pass into di of Erling Haaland. E spin and find Foden small space in di box wey score.
70 mins: SUBSTITUTION. Fred come in for Jadon Sancho.
64 mins: GOAL! Man City 5-1 Man Utd
Erling Haaland don score im third hat-trick in a row.
56 mins: GOAL! Man City 4-1 Man Utd
Antony, di Brazillian score sweet goal for united.
54 mins: Better from United as dem dey move wit di ball for City boc.
53 mins: Kevin de Bruyne and Erling Haaland, for di first time no connect well.
49 mins: Christian Eriksen win di ball from Ilkay Gundogan for di middle but Joao Cancelo collect am back within seconds.
Man City 4-0 Man Utd
46 mins: SUBSTITUTION. Luke Shaw enta for Tyrell Malacia for half-time for Manchester United.
HALF-TIME
Man City 4-0 Man Utd
Dis na pure domination from Manchester City. Dem dey play like team wey dey vex. Dem no give any chance to United to settle down through out di first half.
So far, na embarrassing game for Manchester United. Dia fans don begin leave di stadium even before di end of di first half.
First Half: KICK-OFF
Man City 4-0 Man Utd
43 mins: GOAL! Phil Foden score im second goals for city
37 mins: GOAL! Erling Haaland again.
Man City 3-0 Man Utd
33 mins: GOAL! Man City 2-0 Man Utd
Erling Haaland head in corner to give City dia second goal.
30 mins: MISSED CHANCE.
De Gae save Kevin de Bruyne shot from outside 18 yard box.
28 mins: Man City still dey in control of di ball. United don try regoup and re-organize dem sef. But City still dey in control.
25 mins: Erling Haaland dey try break into united defence wit pass from Kevin de Bruyne but dem stop am.
23 mins: Malacia chop yellow card for bringing down Foden.
21 mins: Man City 1-0 Man Utd
Man city dey fully in charge of di game
18 mins: BALL HIT BAR.
Ilkay Gundogan and Kevin de Bruyne stand over di free kick but na di German take am.
Gundogan curl di ball pass united wall to beat David de Gea but e hit right post.
17 mins: Jack Grealish don start well. E just dey throw passes hear and there. E later find Kevin de Bruyne and Lisandro Martinez bring am down.
15 mins: Kyle Walker miscue Bruno Fernandes long ball and e come through to Jadon Sanchez.
14 mins: Manchester United try to keep di ball for some minutes but Tyrell Malacia comot im eye from di ball and di ball enta throw in.
13 mins: Marcus Rashford get ball to chase down di left but Ederson read am well to clear di ball.
12 mins: Manuel Akanji dey hold am tight for city defence. E no dey give Bruno Fernandes chance.
7 mins: GOAL! Man City 0-0 Man Utd. Phil Foden put Man city ahead for di Etihad stadium.
5 mins: City get 3 in one chance but dem survive am.
2 mins: Erling Haaland win di first afta e hold up play for middle. Jack Grealish get di oda one and Diogo Dalot get yellow card.
1 min: Game don start
Manchester city vs Manchester united Line-ups
Manchester city: Ederson, Walker, Akanji, Aké, Cancelo, De Bruyne, Gündogan, Bernardo Silva, Foden, Haaland, Grealish.
Manchester united: de Gea, Dalot, Varane, Martínez, Malacia, McTominay, Eriksen, dos Santos, Bruno Fernandes, Sancho, Rashford
Manchester city vs Manchester united head-to-head
Manchester City fit win three consecutive league games against United for di first time since di run of four between April 2013 and November 2014.
United fit lose dia 18th Premier League game against City.
E go equal dia highest number of defeats against a specific opponent
Di respective away side don win dis Premier League fixture 21 times.
No oda don produce more victories for di away team.
Manchester city vs Manchester prediction
For all di positivity about Manchester United progress under Erik ten Hag, make you no forget say na Manchester City dem dey play.
City na di best team for England and by far di best team for Manchester.
We see how much chance Arsenal create against United for dia last league game, but dem fail to take dem.
If City play anywhere near wetin Arsenal play - dem go score plenty goals.
Although United cause dem some problems on di counter, but e dey likely say dem go lose.
Prediction: 4-1