Atletico Madrid vs Man City highlights: Manchester City set up ogbonge semi final match wit Real Madrid

Rodri and Llorente

Wia dis foto come from, Getty Images

Manchester City don set up ogbonge semi final match for di Uefa champions league wit Real Madrid.

Dis na afta dem hold off Atletico Madrid to a 0-0 draw for di second leg of dia quarter final game for Spain.

City keep dia cool and play wit plenty composure through di game even though Athletico show dia sef for second half.

Ilkay Gundogan for end di game easily for di English side if to say e score one close range shot but Oblak save am.

Atletico end di game wit 10 men wen defender Felipe chop im second yellow card for a dangerous foul on Phil Foden.

Second half

46 mins - Di hosts, Atletico Madrid don restart play.

50 mins - Atletico don mount for City half, dem need a goal but so far e no clear wia e go come from.

57 mins - Anton Griezmann shot go very close to open di scoring. Ederson stretch to stop am but di shot go wide.

65 mins City make dia first substitution afta De Bruyne get injury. Di Belgian dey replaced by Raheem sterling.

67 mins - Anoda City player don injure, dis time na Kyle Walker. But e look like im dey try see if e go kontinue.

69 mins - Substitution Renan Lodi, Koke and Griezmann don come off, Koke, Rodrigo de Paul and Angel Correa don enta di game.

70 mins - Only one minute afta im come on, Rodrigo de Paul fire shot wey go past di right post.

73 mins - Substitution for Man City. Wlaker no fit continue, Nathan Ake don replace am.

77 mins: Substitution for Man City. Fernandinho enta for Bernando Silva.

80 mins: Llorente chop go miss Athletico next match afta e chop yellow card for foul.

83 mins: Substitution for Athletico. Suarez enta for Lemar and Gunha for Jao Felix.

85 mins: Man City don dey press Athletico. Dem don spen more time for dia half in di last 5 mins.

86 mins: Na small time remain make di game end and both teams don suddenly begin press.

87 mins: Man City goalkeeper Ederson make crucial save afta ogbonge shot from Corea.

89 mins: Di game don dey on hold afta Filipe kick Foden wey make Man City players vex. Di situation dey rowdy.

90 mins: Athletico defender Filipe don chop Red card for di foul on Foden. Savic also get yellow card. Nathan Ake of Man City for pushing Savic.

90 mins +: Officials don add 9 extra minutes sake of di incident.

96 mins: Athletico goalkeeper Oblak save one -on one shot from Gundogan.

97 mins: Cancelo chop yellow card for poor challenge on Carresca for di edge of Man City 18 yard box.

98 mins: Ederson save last minute free kick from Athletico. E hit am go throwing.

Full Time: Atletico Madrid 0-0 Manchester City.

First half

1 mins - Di match don start.

4 mins - Atleti break into City defence wit crose from Lemar, Walker clear di ball.

10 mins - Kevin De Bruyne cross corner and John Stones nod di ball, but e go just over di bar.

13 mins - Phil Foden need treatment, e be like say im go kontinu.

18 mins - City goalkeeper Ederson rush out to head clear one long pass wey threaten di City defense.

24 mins - Yellow card for Felipe.

30 mins - Ilkay Gundogan control good pass inside di eighteen yard box, but im effort hit di post. Im rebound and anoda shot dey blocked.

34 mins - Phil Foden dribble im way past some Atleti defenders but im run into traffic as e later lose di ball.

36 mins - Di game neva get any real chance since dat Gundogan shot hit di post.

38 mins -Atletico Madrid need one goal to equal di tie as dem still dey lose on aggregate.

Half time Atletico Madrid 0-0 Manchester City

Atletico Madrid vs Man City line up

Atletico Madrid XI: Oblak; Llorente, Savic, Felipe, Reinildo; Lemar, Kondogbia, Koke, Lodi; Griezmann, Joao Felix.

Man City XI: Ederson; Walker, Stones, Laporte, Cancelo; Bernardo Silva, Rodri, De Bruyne; Mahrez, Gundogan, Foden.