You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Frank Lampard: Everton confirm appointment of di former Chelsea coach
- Author, Phil McNulty
- Role, Chief football writer
Premier League side Everton don confam Frank Lampard as dia new manager.Lampard appointment dey happen over a year afta im former club Chelsea sack am.Di former Blues legend replace Rafael Benitez as permanent coach of di Toffees.Lampard sign two-and-a-half year deal wey go make am dey di club until June 2024. "Na big honour for me to represent and manage dis kain club wey big and get tradition like Everton Football Club," e tok.
Frank Lampard finalise di two-and-a-half-year deal to become Everton new manager and e complete di formalities of him contract on Sunday.
Dem offer Lampard di job afta Everton top boss dem conduct a final round of interviews on Friday.
Di interviews include Lampard, Portuguese coach Vitor Pereira and current caretaker manager Duncan Ferguson.
Lampard, wey don dey out of di game since afta Chelsea sack am as manager a year ago, go take charge of im first game for di FA Cup fourth-round tie at home to Brentford on Saturday before a crucial Premier League relegation match away to Newcastle United one week on Tuesday.