You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Belgium vs France: Wetin to expect for di UEFA Nations League semi-finals
Belgium national team go face France on Thursday October 7 for dia UEFA Nations League semi-final match.
Winner of di match go face Spain for di finals wey go happun on Sunday. Spain beat Italy 2 - 1 on Wednesday for di first semi-final match wey dem play for San Siro.
France dey unbeaten for dis edition of di tournament as dem bin collect five wins and one draw for di group stage. Belgium win five games and loose one match for di group stage too.
Last time di two teams meet, France beat Belgium 1 - 0 for di 2018 world cup semi-finals.
Time and Place of di match
Di venue of di match na for di Allianz Stadium, Turin, Italy wey be home ground of Juventus football club.
Na by 7:45pm west Africa time di match go kick off.
Stars to watch
Kareem Benzema, Kylian Mpappe, Paul Pogba and Antione Griezmann go lead di France squad into di game, while Chelsea new signing Romelu Lukaku plus Eden Hazard and Kelvin De Bruyne go lead di Belgium team.
Tori be say France midfielder Ngolo Kante no go feature for di match as im test positive to covid 19.
End of Di one wey oda users dey read well well
News about di UEFA League
Cristiano Ronaldo and im Portugal brothers win di first edition of di UEFA nations league. Dem beat Netherland 1 - 0 to carri di trophy on home soil for 2019.
Di finals of di second edition go happun on Sunday for di San Siro stadium for Italy. San Siro na di home ground of AC Milan FC. Italy wey loose di first semi final match to Spain go face looser of dis second semi-finals on same Sunday for di third place match.