Mbappe: See wia Real Madrid £137m bid dey for 10 most expensive football transfers

Wia dis foto come from, Getty Images
Spanish football club Real Madrid don put €160m bid for Kylian Mbappe.
If di striker current club Paris St Germain accept di money, e go put di French star ontop list of 10 most expensive football transfers - for di second time.
Dis na because Mbappe transfer fee from Monaco go PSG for €145m na second highest on top dis list (if we comot di €35m bonus money wey follow di deal come)
Di contract of di 22-year-old World Cup winner go expire for June 2022.
Since 2017 wey im join di current Ligue 1 champions, Mbappe don score 133 goals in 174 games for PSG and win three Ligue 1 titles and three French Cups.
PSG, wey never respond to di bid, bin sign Argentina forward Lionel Messi earlier dis month after e comot Barcelona.
Meanwhile di only business wey di Los Blancos don do dis summer na di free transfer of David Alaba from Bayern Munich.
But pipo inside football world don reason am say if Real Madrid somehow manage buy Mbappe, some oda big transfers for football world fit follow.
End of Di one wey oda users dey read well well
E no dey clear wetin Cristiano Ronaldo future be for Juventus and tori be say PSG dey interested in am, wey mean say if dem sign di Portugal player, e fit dey play inside same team wit Messi, im rival for di best in di world for more than 10 years.
10 most expensive football transfers (if Real Madrid get Kylian Mbappe)

Wia dis foto come from, Getty Images
- Neymar - Barcelona - PSG - €222m (2017)
- Kylian Mbappe - PSG - Real Madrid - €160m (?)
- Kylian Mbappe - Monaco - PSG - €145m (2017)
- Joao Felix - Benfica - Atletico Madrid - €126m (2019)
- Philippe Coutinho - Liverpool - Barcelona €120m (2018)
- Antoine Griezmann - Atletico Madrid - Barcelona - €120m (2019)
- Jack Grealish - Aston Villa - Manchester City - €117m (2021)
- Romelu Lukaku - Inter - Chelsea - €115m (2021)
- Ousmane Dembele - Borussia Dortmund - Barcelona - €105m (2017)
- Paul Pogba - Juventus - Manchester United - €105m (2016)
With dis Real Madrid bid inside di list, Gareth Bale transfer fee of €100.8m from Tottenham Hotspurs go Real Madrid for 2013, don drop comot from top 10.












