Samuel Takyi: Tokyo 2020 Olympics medal dey guaranteed for Ghana boxer, dia first Olympic medal since 1992

Samuel Takyi

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Samuel Takyi

20-year-old Samuel Takyi don end Ghana 29 year wait for Olympic medal.

E sure for Ghana as Takyi beat Colombia David Avila Ceiber for di featherweight boxing division of di Tokyo 2020 Olympics to get sure place for di semi-final.

Na from di back wey Takyi take win 32-year old two-time Olympic Colombian champion on a 3-2 split decision victory for di early hours of Sunday.

As e secure dis semi-final spot, Takyi dey guaranteed of at least bronze medal before e go take on American Duke Ragan for dia semi-final fight on Tuesday, August 3.

Dis one na because for boxing for di Olympics, both di pesin wen win and loss go get bronze medals.

Dis go be Ghana first Olympic medal since di Black Meteors win bronze for di 1992 games for Barcelona.

And di first boxing medal since middleweight Prince Amartey wey take bronze for Munch in 1972.

Takyi join Ghanaian Olympic greats Clement Quartey, wey be light welterweight wey win silver for Rome for 1960, Eddie Blay, bronze light welterweight medallist from Tokyo 1964 and Prince Amartey wey make history for Munch in 1972

Ghana gold-medal threat Samuel Takyi go fight Duke Ragan from USA on Tuesday 3 August 2:30am Ghana time.