Constitution review in Nigeria: Senate wan review 1999 Constitution - How e involve you

Nigeria Senate wan review di 1999 constitution.

Dem go begin wit zonal public hearing for di six geopolitical zones later dis month.

Dis move na to adjust di kontri law book, Senate Committee on di Review of di 1999 Constitution tok for statement.

Many pipo inside di west African kontri don argue say di 1999 constitution wey dey govern Nigeria no dey work well.

Di Public hearing go hold for for 12 state capitals at di same time as centres.

E mean say two centres for each geopolitical zones go hold public hearing from Wednesday, 26th May to Thursday 27th May.

E dey free to attend to di general public according to di statement wey di Deputy Senate President, Ovie Omo-Agege sign.

How di constitution review involve you

Na sixteen main issues dem dey follow tok for inside dis public hearing.

Na here di mata involve you to go tok your own ontop di following:

  • Gender Equality and Women Participation for goment
  • Di Federal Structure for governance and power sharing
  • Local Goment autonomy
  • Revenue Allocation
  • Establishment of State Police
  • Justice reform for judiciary
  • Electoral reform
  • Socio-economic rights as dem write an for Chapter II of di constitution
  • Residency and Indigeneship
  • Removal of immunity for criminal cases
  • How long e suppose take for Passage of Appropriation Bill
  • State and Local government creation
  • Independence of Accountant General, Auditor General and Attorney General of di Federation
  • FCT Administration
  • Di way di Legislature dey operate
  • Constitutional roles for Traditional leaders

Wia di Zonal Hearings go take place

North Central

Jos Centre go represent Plateau, Nasarawa and Benue

Minna Centre - Nigeri, Kwara, Kogi and Abuja

North East

Bauchi Centre - Bauchi, Yobe and Borno

Gombe Centre - Gombe, Taraba and Adamawa

North West

Kaduna Centre - Kaduna, Kano, Jigawa and Katsina

Sokoto Centre - Sokoto, Kebbi and Zamfara

South East

Owerri Centre - Imo and Abia

Enugu Centre - Enugu, Ebonyi and Anambra

South South

Asaba Centre - Delta, Edo and Bayelsa

Port-Harcourt Centre - Rivers, Cross River and Akwa Ibom

South West

Lagos Centre - Lagos Oyo and Ogun

Akure Centre - Ondo and Osun

Before dis process begin, many experts don tok say 'na restructuring fit solve di plenti palava wey dey face Nigeria'.