Champions League final: Manchester City vs Chelsea, see five tins you need to know about di final for Portugal

Manchester City book dia place for di season Champions League final afta dem win dia semi-final tie against Paris Saint-Germain on Tuesday.

And Chelsea go join Pep Guardiola side for Portugal following dia victory against Spanish side Real Madrid.

Di blues beat Real 2-0 for Stamford Bridge to win di tie 3-1 on aggregate.

Dis season final of Europe ogbonge football competition go tough, City dey look to win dia first ever title and Chelsea dey look to add to di ones wey dem don win before.

Dis na everything you need to know.

When be di final?

Dem go play di final on Saturday 29 May and di kick-off time go be 8pm GMT.

Where dem go play di final?

Di Champions League final between Chelsea and Manchester City go take place for Portugal.

Uefa say dem move di game from Turkey to di Portuguese city of Porto sake of coronavirus restrictions.

How to watch di final

As e don be throughout di tournament, na Supersports go broadcast di match live.

Dem go allow fans attend di final?

According to Uefa, 6,000 fans from each club able go fit watch di final physically inside di stadium.

Portugal dey for England green list so players and fans fit attend without need to quarantine when dem go back home. Meanwhile Turkey dey on di red list.

Na all English final

Di two clubs wey reach dis season Uefa Champions League final come from English Premier League.

Manchester City don already enjoy cup success dis season under Pep Guardiola dem beat Tottenham 1-0 to clinch di Carabao cup for April and dem dey on course to win di league.

As for Chelsea since Thomas Tuchel take charge of di club di tins don change for di Blues, dem don qualify for di final of di FA Cup and dey fourth position for league table