Nigeria vs Lesotho lineup: Super Eagles and Crocodiles Afcon qualifiers prediction, venue & how to watch di match

Wia dis foto come from, Super Eagles
Super Eagles don secure di 2022 Africa Cup of Nations [Afcon] , but dem go fit maintain dia winning ways for Teslim Balogun Stadium today?
Dat na di big question as Nigeria lock horns with Lesotho for dia last African Cup of Nations qualifiers today.
Nigeria Super Eagles vs Crocodiles of Lesotho qualifiers match go kick off 17:00 Lagos time on Tuesday 30th March, 2021.
And di home side remain unbeaten inside Group L, so wetin dey at stake for today game?
Well, di three time African champions [Super Eagles] book dia ticket for di January 2022 Afcon last week wit a win over Benin, but a chance still dey for Lesotho.
Di Crocodiles never win any competition since August 2019, dem only lost two of dia five matches so far.
For Lesotho to get any chance to qualify for di January 2022 Afcon wey Cameroon det host, dem bin need to win Sierra Leone last Satuday but only manage get dia third draw for di group stage.
Tori be say di Southern African national football team get three points, meaning say di third position still open inside Group L, if dem fit win today game.

Wia dis foto come from, Super Eagles
Coach Gernot Rohr boys don win three and draw two of dia five matches to collect 11 points, wey put dem four points ahead of di second-placed
Thabo Senong side suffer 4-2 loss to Nigeria for dia first leg match in November 2019 before going down 1-0 against Benin inside dia next qualification match almost one year later, but di national team don play out goalless draws with Benin and Sierra Leone in dia last two games.
How to watch Nigeria vs Lesotho?
Di match go show live on Nigeria Television Authority (NTA).
[Nigeria vs Lesotho] Movement restriction around Teslim Balogun Stadium
Meanwhile, Lagos State Traffic Management Authority [LASTMA] don issue a travel advisory, restricting movement of motor ahead of di Super Eagles AFCON clash against di Crocodiles of Lesotho.
Di Agency wey dey control Lagos road traffic Inside one tweet say "all vehicular movement around di stadium must stop from 10 am till 10 pm.
Di tweet further advise say "vehicles wey dey come towards Teslim Balogun from Ojuelegba and Alaka/Eric Moore fit only pass through di flyover.
Nigeria vs Lesotho lineup

Wia dis foto come from, CAF

Wia dis foto come from, NFF











