Ghana referees chop beatings from football fans sake of alleged poor officiating

Wia dis foto come from, GTV/Facebook
Ghanaian football referees dey nurse dema wounds after dem chop beatings from angry fans.
De incident wey happen during some Division One League match mess de game up.
Fans of home side Mighty Royals bore de referees in dema game against Tano Bofoakwa over allegations of poor officiating.
Dem gather for de main gate of de football park, later wey dem storm de pitch.
Police intervene in de matter before de beatings stop, but by then de referee and two linesmen sustain various injuries.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Some football fans condemn de action of de supporters who mess de game up.
CEO of Tano Bofoakwa, Kojo Alphonso explain say "de whole thing start during warm up, dem at t dey beat my players, prevent de referees from entering de dressing room."
"We play de match, wey dem start de assault de referee, coach and myself... I no know why we dey bring back love of de game... wey dem dey beat people" he add.
End of Di one wey oda users dey read well well
BBC Pidgin try get word from Referees Association of Ghana but so far dem no comment on de matter.
Ghana Football Association (GFA) give directive say football fans no for enter stadiums during match days sake of Covid-19 safety issues.
Despite dis directive, concerns emerge about how de supporters flout de ordrer den cause commotion on top.












