Oap Nkubi: Victor Nwaogu share how e meet im wife

Wetin we call dis Video, Nkubi love story

Nollywood actor and on air personality, Victor Nwaogu alias 'Nkubi small stout' bin tension social media wen e announce say im don comot from singles market.

Soon aftawards, photos of di actor wit e boo, Nkeiru begin fly upandan for social media.

Now, di two of dem don officially do dia traditional marriage rites.

For dis interview wit BBC Pidgin, Victor and e wife share how dem take mit and why dem feel say "di height or pocket size of man or woman no matter for marriage".

Video journalist: Sarah Tiamiyu