You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Lekki Toll Gate Lagos Nigeria [EndSARS protest]: See wetin Macaroni tok afta police release am
Popular comedian and content creator Debo Adeday aka Mr Macaroni, don comot to tok say goment get duty to protect all Nigerians afta im regain e freedom following im arrest on Saturday 13 February, 2021.
Mr Macaron i wey im real name na Debo Adedayo tok for inside tweet say "Na di goment and di goment alone dey responsible for any insecurity for Nigeria". Even as im add say Nigerians all be one.
Dis dey come afta dem release am on bail from prison on Saturday wen police bin arrested am for di proposed venue of di "Occupy Lekki Toll Gate" protest.
E don come release video on top wetin e se for inside police hand afta dem arrest am.
E accuse di police say dem beat am and di oda members go di toll gate on Saturday and even say dem bin scata im phone.
E bin dey do Instagram live wen dem bundle am and some oda protesters enta black maria before police come collect im phone.
E tok say di Police bin cari dem go Adeniji, for Lagos wia "dem beat us come naked us."
Mr Macaronii allege say, "Police tell us say dem go kill us and nothing go happun, say if na night, all of una for don die."
End of Di one wey oda users dey read well well
Oga Macaroni follow add say make pipo no too dey blame celebrities say dem no come out for protest on top say im sef bin no wan go but im bin sabi say if e no go for di protest, dem for "kill pipo on top say nobodi go sabi wia dem cari di pipo go".
E follow add say, im dey go hospital on top di wound wey dem wound am as a result of im arrest.
Police condemn molestation of arrested protesters
Meanwhile, di Commissioner of Police, Lagos State, CP Hakeem Odumosu, don condemn di way im officers handle di EndSars protesters as im describe one viral video as "unprofessional and inhuman".
Di commissioner for inside statement order di Deputy Commissioner of Police, State CID, Panti, DCP Adegoke Fayoade, to "analyse di video and bring to book whoever dey responsible for di act."CP Hakeem Odumosu add say di command go fish out dose wey dey responsible for di molestation and ensure say dem punish dem for dia unprofessional conduct.