Paris Saint Germain players test positive for Covid-19

Neymar

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Neymar hold di record of di most expensive football transfer for history
Read am in 1 mins

As di French Ligue 1 2019/20 champions dey prepare to start anoda campaign, revelation say three players don get coronavirus go hit dem well-well.

Paris Saint Germain bin don announce earlier ontop Twitter say three of dia players get di virus, although dem no release informate about dia names.

Now UK tori pipo Sky Sports News dey report say Neymar follow for one of dem, although dem hear di player say im "dey feel good". BBC never fit independently confam dis tori.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Come 10 September, PSG go face Lens for dia first match of di season - away.

PSG also say test go continue for all players and staff for di next few days, so e possible say more positive cases still fit comot.