You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Waec literature expo: West African Examinations Council expose how Literature in English 2020 expo, oda exam paper questions and answers dey leak across Nigeria
English Literature paper na im thousands of final year secondary school students for Nigeria go write on Friday for di on going 2020 West African Certificate Exams SSCE.
West African Examinations Council don expose how Supervisors/Invigilators, Candidates dey leak 2020 expo ahead of di Literature in English questions and answers.
Tori be say since di exams start on Monday 17 August, 2020 plenti expo alias leaked questions and answers don full social media, from wen candidates write General Mathematics, Chemistry practical to wen dem write Physics practical na so so expo dey spread for social media.
Sake of dis palava decide to clear di mata and wetin pipo suppose know. Waec say no leakage of any paper, whatsoever happun.
So how Waec exam papers take leak?
Waec Ag. Head, Public Affairs Demianus Ojijeogu tell BBC Pidgin say di Council Monitoring/Investigations reveal say some Supervisors/Invigilators wey Waec say no dey pure alias unscrupulous and unpatriotic, and in some cases, candidates, dey snap di question papers (while di examination dey in progress) and forward to dia outside collaborators.
Dis collaborators go in turn, provide solutions to di questions wey dem go send to dis customers alais subscribers through some websites, SMS and Whatsapp, even as dis dey against Waec regulation of: Use of cell phones inside di examination hall is not allowed. Di West African Examinations Council tok tok pesin for Nigeria add.
Di Waec Nigeria offial add say some bad eggs alias culprits wey dem gbab as dem dey leak di expo inside Bauchi, Nasarawa and Rivers States don arrest and dem go face di law.
Literature in English exam
Faceless - Book by Amma Darko, Piano and Drums - Poem by Gabriel Okara, Birches - Poem by Robert Frost Breakout, She Stoops to Conquer - Play by Oliver Goldsmith, Native Son - Novel by Richard Wright, Othello - Book by William Shakespeare, Harvest of Corruption - Book by Frank Ogodo Ogbeche na some of di books alias prose literary theory wey Waec go take ask candidates questions to answer.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis na di message Waec send to BBC Pidgin.