You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
See why Adebayor and im club, Olimpia part ways afta four matches
Di contract of former Arsenal, Tottenham and Manchester City striker Emmanuel Adebayor for Paraguayan club Olimpia don end by mutual consent.
Di 36-year-old Togolese striker don play only two times for di club since dem sign am for February, and im no score any goal until di global coronavirus pandemic make di league shut down.
During im arrival plenty fans show for airport to come greet am.
But during di lockdown na im house for Togo im don dey and di club say im return to Paraguay fit cause health risk.
Di club also say di "economic situation di kontri dey go through" follow for why dem end Adebayor contract.
Inside di last match wey Adebayor play for Olimpia 11 March, e collect red card for one dangerous "Jackie Chan" kick wey e use land ontop anoda player chest.