Bundesliga schedule: Live matches return afta coronavirus - See how you fit watch am

Wia dis foto come from, Getty Images
Bundesliga don set record as di first major league to restart during di coronavirus pandemic and for millions of football fans, di main kweshion na how to watch di matches, live.
Two rival clubs Dortmund and Schalke go jam inside one of di six Saturday matches wey dem go play for stadium wey no get fans inside.
If dem win, Dortmund go close reduce to one point di gap wey Bayern dey give dem.
Bayern Munich dey play on Sunday, 17 May.
How to watch for Nigeria, Cameroon & Ghana
Popular cable satellite broadcaster DsTV, no get right to Bundesliga live matches for di 2019/2020 season so na pipo wey get StarTimes dey in luck because na dem get broadcast rights for Sub-Saharan Africa.
In fact, di only kontris for Africa wey StarTimes no cover na Algeria, Morocco, Libya and Tunisia
Meanwhile BetWay wey be sports betting website for Nigeria tweet say all dia customers fit watch di matches live ontop dia website.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Whichever way wey you watch just know say you dey part of one billion pipo wey Bayern CEO Karl-Heinz Rummenigge don gauge say go watch dis weekend live matches
End of Di one wey oda users dey read well well
See Saturday games.
SATURDAY 16TH MAY 2020
B Dortmund 14:30 Schalke
Augsburg 14:30 Wolfsburg
Düsseldorf 14:30 Paderborn
RB Leipzig 14:30 Freiburg
Hoffenheim 14:30 Hertha Berlin
Frankfurt 17:30 B Mgladbach











