Chineme Martins: Wetin you suppose know about di Nassarawa Utd player wey die for pitch

Chineme Martins

Wia dis foto come from, @thenff Twitter

Wetin we call dis foto, Chineme Martins join Nasarawa United for 2015
Read am in 1 mins

Nigeria Football Federation and di League Management Company dey mourn di death of Nasarawa United defender Chineme Martins wey die during dia league match against Katsina United for Lafia on Sunday.

For inside statement LMC chairman, Shehu Dikko, tell di late player family and im club sorry. Im add say "LMC expect to get standard autopsy to find out di cause of di player death.

Di Nigeria football federation say dem dey sad about di player death.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Tori be say Martins collapse for inside di 43 minute of di match and medical officers from di two clubs attend to am for pitch before dem rush am go Dalhatu Araf Specialist Hospital, Lafia wia dem confam say im don die.

Nasarawa United go on to win di match 3-0, Chinedum Ohanachom score hat trick for di game. Di result mean say dem dey 13 position for table with 28 points.

Who be Chineme Martins?

  • Chineme Martins na 23 years old defender from Abia state for south east of Nigeria.
  • Martins join Nasarawa United for 2015/2016 from Ifeanyi Ubah.
  • Im dey part of Nasarawa United team wey reach di final of di Aiteo Federation Cup for 2016