You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
UFC 248: Israel Adesanya na still champion, beat Yoel Romero by unanimous decision
Israel Adesanya na still di middleweight champion afta e defeat Yoel Romero for fight wey many dey say e no sweet.
For di UFC 248 event, di two fighters wey dey undefeated before dis match bin dey hope to go back house with di middleweight belt.
By unanimous decision by di judges declare say na di Nigerian-born Israel, na im fight pass on di night.
Afta round 5 di judges drop scores of 49-46, 48-47, 48-47 wey make Romero para and later complain about.
Di fight wey many sabi pipo say no two sweet to watch, bin happun for di T-Mobile Arena for Las Vegas, American early mor mor on Sunday.
Israel Adesanya wey im nickname na Stylebender, dey represent New Zealand wey be di kontri im parents migrate to.