Samson Siasia: Fifa don ban di former Nigeria international player for life sake of bribe

Wia dis foto come from, Getty Images
Fifa don ban ex-Nigeria international player and former Super Eagles coach Samson Siasia for life.
According to di independent Ethics Committee of Fifa, dem find Siasia, guilty say im show interest to receive bribe ontop football match dem and dis dey against di Fifa Code of Ethics rule.
Dis investigation bin start since 11 February 2019 from Wilson Raj Perumal case wey im attempt to do mago-mago ontop betting.
Di football join body say na dem carry out di investigation and dem work with relevant stakeholders and authority dem.
For dia decision, di adjudicatory chamber say Oga Siasia break law 11(wey be Bribery) of di 2009 edition of Fifa Code of Ethics.
Fifa ban Siasia from everything football weda na (administrative, sports or any oda tin) for both national and international level.

Wia dis foto come from, Getty Images
Siasia also chop fine ontop di mata, Fifa fine am CHF 50,000 wey be $51,025.00. Fifa don tell Siasia about dia decision, di ban go start with immediate effect.
Siasia play 51 times for Nigeria wia im win di 1994 African Cup of Nations. Im record success as coach too, e coach Nigeria Under-23 Olympic squad to win silver for Beijing Olympics games.
End of Di one wey oda users dey read well well
Tins no dey go to well for im personal life, as Jaguda pipo kidnap im mama Beauty Siasia for her village for Odoni, Bayelsa state last month and up till now dem neva release her.
Di kidnappers dey demand ransom money of N70 million.











