You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Fifa Women's World Cup: Cameroon qualify for last 16 but Nigeria leg dey shake
Cameroon win New Zealand 2-1 on Thursday to qualify for di next stage of di Women World Cup.
Ajara Nchout score di winner wit almost di last kick and Cameroon go follow for di last 16.
Di result mean say Nigeria Super Falcons go dey chook eye for di Chile vs Thailand game to know if dem go qualify.
Di Indomitable Lionesses dey enta di next round based on Fair Conduct as dem get less yellow/red cards dan Nigeria.
Dis na how FIFA go choose di first four best third-place teams
1. Points obtained for group matches
2. Goal difference
3. Total number of goals scored for all di matches
End of Di one wey oda users dey read well well
4 . Best disciplinary record