Liverpool v Barcelona make musician Kcee lose N1m bet

KC

Wia dis foto come from, KC Instgram

Wetin we call dis foto, Kcee say im no be Barca fan

Wen Barca do di 'impossible' troway 3-0 advantage against Liverpool on Tuesday, dem break di hearts of millions of dia fans worldwide and also affect many pipo pocket.

One man wey di loss hit for pocket na Nigerian musician Kcee, wey bet one million naira wit Dike Chidozie for who go win di match.

"Di thing be say I no even be Liverpool fan, I be Arsenal fan." Dat na wetin oga Chidozie tell BBC Pidgin.

"Wetin make me get confidence be say I feel say Barca go come wit I-don-care-attitude for di match," im tok.

Chidozie account

Wia dis foto come from, Chidozie

Chidozie

Wia dis foto come from, Chidozie

And e be like say Chidozie na prophet wey don see as e go happun, as di Barcelona players no ginger for di game from beginning to end. Di last goal wia dem dey 'sleep' wen Liverpool play corner score, capture dia attitude throughout di game.

"I tell KC say make we no argue too much, say make we just bet".

"Na my lucky pot be dat. Wen di game na 3-0 na im I send am my account number, in case im no get am again," im tok.

Chidozie

Wia dis foto come from, Chidozie Instagram

Wetin we call dis foto, Chidozie say na only am sabi how im wan take spend di moni

But di Arsenal fan no go carri im 'goodluck' go near im club wey dey play Europa League match against Valencia on Thursday.

"Arsenal na like your girlfriend, dem fit break your heart anytime."

On how im go take spend di moni, Chidozie say na "personal."