Ajax vs Tottenham: Lucas Moura suppose get statue - Eriksen

Lucas Moura

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, All five of Lucas Mouras goals inside dis season Champions League come for away match

Lucas Moura "deserves to get one statue" afta im hat-trick land Tottenham ontop di all-English Champions League final, na wetin im team-mate Christian Eriksen yarn.

Ajax lead 3-0 on aggregate - but Moura goals, including di 96th-minute winner, send Tottenham through on away goals to face Liverpool on 1 June.

Moura himself call am "di best moment of my career".

Eriksen say; "na game wey suppose make pesin laff; we bin really dey far down, we try to fight back, we just dey lucky."

Di Denmark playmaker add say: "We gat to fight. We don rest.

Even Ajax manager Erik ten Hag don reveal give Express.co.uk say him warn im stars about Tottenham comeback.

Na for half time on Wednesday night wen di score board still be 3-0 (on aggregate), before Lucas Moura hat-trick seal di collapse for di Dutch side.

Tottenham go now face Liverpool inside di Champions League final for Madrid on June 1.