You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Women's World Cup: Nine kontris dey beg FIFA say dem wan host for 2023
Nine kontris on Tuesday apply to world football goment FIFA say dem want host di 2023 Women World Cup.
South Africa, Argentina, Australia, Bolivia, Brazil, Columbia Japan, New Zealand na im don declare dia interest.
North and South Korea fit join hand bid for di competition
World football join body say each of di Football Association get until 16 April 2019 to submit dia bidding registration.
"FIFA go make sure say dis process dey open, with solid commitment to human right," na wetin dem tok inside statement.
"Di result of each ballot and di votes of our members dem for FIFA Council go dey open for everybodi."
England go host di next Women European championship for 2021, as e be say na only dem bid.
Di 2019 World Cup go happun for France from 7 June to 7 July.
End of Di one wey oda users dey read well well