Efe Sodje former Super Eagles player and im brothers go jail afta dem kolobi charity money

Wia dis foto come from, PA
Former Super Eagles player Efe Sodje and im brothers Stephen Sodje, and Bright Sodje dey jail for UK afta dem kolobi money from dia own charity wey dem set up to epp poor children for Africa.
Court bin find di Ex-footballers Efe 46, Stephen 43, and ex-rugby player Bright, 52, guilty and jail dem for fraud for 2017.
Na now dem fit report di case after dem finish di trial of former Reading and Nigeria footballer Sam Sodje, 39 wey dem clear for Central Criminal Court, Old Bailey, London for money laundering.
Tory be say for di trial for 2017 dem hear how di family set up di Sodje Sports Foundation (SSF) for 2009, to help provide facilities in Nigeria.
Prosecutor Julian Christopher QC say all di money wey dem get for di black-tie dinner, auction, charity football match dem and clay pigeon shoot enter Sodje bank accounts.
For 2011, dem bin do gala dinner for Lowry Hotel for Manchester SSF and di Royal Manchester Children's Hospital.
Di £150 per pesin black-tie dinner raise almost £11,500, but oga Christopher say "no penny" go di hospital.

Wia dis foto come from, Getty Images
Judge Michael Topolski QC tell di defendants: "Una don bring shame for una self and una family."
End of Di one wey oda users dey read well well
Im say "di fund receive at least £63,000", wey no involve cash donation.
Di defendant do everytin possible to make sure say dem hide all di correct records.
All di good work wey dem don do before go don spoil because of di wururu wey dem do", na wetin di judge add put.
Stephen Sodje, of Bexley, chop two years and six months for prison sake of say im collect £30,000 of di charity money.
Efe Sodje, of Cheadle for Greater Manchester, wey be di face of di charity chop 18 months for prison sake of say im collect £7,500 from di SSF and unknown amount from clay pigeon shooting event.
Bright Sodje, of Sale for Greater Manchester, chop 21 months sake of say im sign cheques to oda family members and collect £3,000 from di charity all in total reach £18,000.
Tori be say because of di separate money-laundering case na im make dem bin no fit report dia mata as e dey hot.

Wia dis foto come from, Getty Images
For January 2018, dem clear Efe Sodje of money laundering for Old Bailey but convict Emmanuel Ehikhamen, 53, of South-East London, and Andrew Oruma, 50, of Bexley, south London.
Di case against Sam Sodje collapse but dem start again for 7 January 2019.
Dem charge oga Sodje, wey play for Charlton Athletic, Brentford and Leeds with four counts say im do fraud use bank accounts to wire money from company dem around di world.
Dem find am guilty of two of di charges dem on 14 January and clear am of di remaining two counts.
Dem also implicate another of im brother Akpo Sodje, 37, for di matter but im run go Dubai and no gree come back to Britain make dem question am ontop di mata.












