You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
U-20 Women World Cup: Falconets nack Haiti to collect dia first win
Nigeria women U-20 team win Haiti 1-0 for dia second match for di FIFA 2018 Women World Cup for France.
Rasheedat Ajibade score penarity for first half to give di Falconets dia first win for di competition.
Di Nigeria team loose dia first match 0-1 to Germany on Monday and for fit comot for di competition if dem bin lose on Thursday.
Nigeria dey Group D wit Germany, Haiti and China, wey dem go play on Monday for dia last match.
Ghana na di only oda Africa team for di World Cup and dem loose dia first two matches. Dem chop 4-0 from Holland and anoda 4-1 from France.
No Africa kontri don win di competition since e start for 2002 and evri two years dem dey play am.