You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Moses Simon sign five year deal wit Levante
Spain La liga club Levante don sign Nigerian international player Moses Simon from KAA Gent for five year contract.
23-year-old Simon been dey enta di final year of im contract with Gent, wia im win di Belgian title for 2015.
Di Spanish team confam di deal for dia website, but dem not tok how much dem buy di player.
Di Spanish team welcome am for dia Twitter handle.
Before im move go Belgium, im play for Slovak side AS Trencin for one year before im play im first match for Nigeria Super Eagles for 2015.
Simon na key player for Super Eagles during di qualifying campaign for World Cup but miss di tournament because of Injury.